Live video:Court dismiss bail application wey Nnamdi Kanu file

 


Di Federal High Court wey dey siddon for Abuja don dismiss di bail application of di leader of the Proscribed Indigenous People of Biafra (Ipob), Nnamdi Kanu.

CLICK TO WATCH THE VIDEO HERE

Trial Judge, Justice Binta describe di application as “gross abuse of court process.”

Justice Nyako for her ruling say di suit na attempt to continue to litigate on issues wey dem bin don rule on top.

She therefore advise di applicant to approach di Court of Appeal on di issue of bail.

Justice Nyako adjourn di mata to 14 November for mention and to also know di outcome of di case for Appeal court.


CLICK TO WATCH THE VIDEO HERE

We dey fight to defend our pipo not to kill dem' - Kanu

Meanwhile di leader of di Indigenous People of Biafra, Nnamdi Kanu say di Biafra struggle na to fight for di pipo and not to kill- kill di pipo of di region.CLICK TO WATCH THE VIDEO HERE

 Kanu tok dis wan in response to di outcome of im bail application for di Federal High Court, Abuja for one interview afta im trial on Tuesday.

"I no dey disappointed, why I go dey, na wetin we expect to happun, but I want our pipo to dey very calmCLICK TO WATCH THE VIDEO HERE, I want Biafra land to dey peaceful. calm and very very peaceful.

We dey fight to defend our pipo, not to kill dem. We dey fight to defend dem, dats why I dey here, and we go continue to do so until we get victory." E tok.

CONTINUE READING:

CLICK TO WATCH THE VIDEO HERE


Post a Comment

Previous Post Next Post